Lingua   

Rise

Seun Kuti
Lingua: Inglese (Nigerian Pidgin)


Seun Kuti


Our ear don full for your words
Our stomach still empty
Our ear don full for your words
Our stomach still empty
Our ear don full for your words
Our stomach still empty
Our ear don full for your words
Our stomach still empty
Our ear don full for your words
Our stomach still empty

I dey cry for my country
When I see am in the hands of these people
(Yea yea)
I dey cry for my country
When I see am in the hands of these people
(Yea yea)
I dey cry for Africa
When I see am in the hands of these people
(Yea yea)
Yea Yea na business dem dey take am dey do
Yeparipa
(Na business to dem ohohoh)

Na business dem dey take our country dey do
(Na business to dem ohohoh)
Na business dem dey do that’s why dem dey share am like oga
(Na business to dem ohohoh)
Na business dem dey do that’s why dem no dey share am with the people
(Na business to dem ohohoh)
Na business dem dey do, dem dey sell our continent away

Dem dey sell am every day and dem dey bring the people down (them dey bring us down)
Our children no dey chop and we still no get work
(ko si se lode oh)
Dem dey sell am every day an dem dey bring the people down
(won wow a n le ho)
We must rise up one day
We must rise up

We must rise up I say
We must rise up I say
We must rise up against the petroleum companies
We dey use our oil to destroy our land oh ho
We must rise against the diamond companies
Wey dey use our brothers as slave for the stone
We must rise against our African rulers
Wey be black man for face, white man for yansh
We must rise against companies like Monsanto and Halliburton
Wey dey use their food to make my people hungry

Oh yes, we must rise
(Rise Rise Rise up)
To grow our own food
(Rise Rise Rise up)
For our children to go school
(Rise Rise Rise up)
Make we get work to do
(Rise Rise Rise up)
Make our life go dey better
(Rise Rise Rise up)



Pagina principale CCG

Segnalate eventuali errori nei testi o nei commenti a antiwarsongs@gmail.com




hosted by inventati.org