Beasts Of No Nation
Fela KutiOriginale | |
BEASTS OF NO NATION Ah - Let’s get now into another, underground spiritual game Just go to help me the answer, go to say, "Aiya-kata"- Oh ya O’feshe-Lu [Chorus] Aiya kata O’feshe- g’Ba O’feshe-Woh [Chorus] Aiya kata O’feshe-Weng Aiya kata Aiya Koto Aiya Kiti Aiya Kutu O’feshe-Lu [Chorus] Aiya kata O’feshe- g’Ba Oh... Basket mouth wan start to leak again, oh- [Chorus] Basket mouth wan open mouth again, oh Abi you don forget I say I sing, ee-oh [Chorus] Basket mouth wan open mouth again, oh Oh, I sing, I say, I go my mouth like basket, ee-oh, Malan Bia-gbe-re Basket mouth wan start to leak again, oh- [Chorus] Basket mouth wan open mouth again, oh Fela, wetin you go sing about? [Chorus] Dem go worry me… Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry [Chorus] Dem go worry me Dey wan to make us sing about prison Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town Dey wan to know about prison life Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town Fela, wetin you go sing about? [Chorus] Dem go worry me Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry The time weh I dey, for prison, I call am “inside world” The time weh I dey outside prison, I call am “outside world” Na craze world, na be outside world [Chorus] Craze world Na be outside- da police-i dey Na be outside- da soldier dey Na be outside- da court dem dey Na be outside- da magistrate dey Na be outside- da judge dem dey Na craze world be dat Na be outside- Buhari dey Na craze man be dat Animal in craze-man skin-i Na craze world be dat Na be outside- Idia-gbon dey Na craze man be dat- oh Animal in craze-man skin-i Na craze world be dat Na be outside- dem find me guilty Na be outside- dem jail me five years I no do nothing Na be outside-dem judge dey beg ee-o Na craze world be dat, Na craze world be dat Na be outside- dem kill dem students Soweto, Zaria, and Ife Na craze world be dat, ee-oh Na craze world be dat, Na be outside- all dis dey happen Na craze world be dat, ee-oh Na craze world be dat, ee-oh Na craze world be dat, ee-oh Na craze world be dat, ee-oh Na craze world be dat, ee-oh….. Make you hear this one War against indiscipline, ee-oh Na Nigerian government, ee-oh Dem dey talk ee-oh “My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline” Na Nigerian government, ee-oh Dem dey talk be dat “My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline” I never hear dat before- oh Make Government talk, ee-oh “My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline” Na Nigerian government, ee-oh Dem dey talk be dat Which kind talk be dat- oh? Craze talk be dat ee-oh Na animal talk be dat – oh Na animal talk be dat – oh [Chorus] Many leaders as you see dem [Chorus] Na different disguise dem dey-oh [Chorus] Animals in human skin [Chorus] Animal-I put-u tie-oh [Chorus] Animal-I wear agbada [Chorus] Animal-I put-u suit-u These disguising leaders ee-oh, na wah for dem Dem-o hold meeting everywhere, dem reach America Dem call the place, the “United Nations” Hear-oh another animal talk Wetin united inside “United Nations”? Who & who unite, for “United Nations”? No be there Thatcher & Argentina dey No be there Reagan & Libya dey Is-i-rael versus Lebanon Iran-i-oh versus Iraq-i East West Block versus West Block East No be there dem dey oh- United Nations Dis “united” United Nations One veto vote is equal to 92 […or more, or more] What kind sense be dat, na animal sense [Chorus] Many leaders as you see dem [Chorus] Na different disguise dem dey-oh [Chorus] Animals in human skin [Chorus] Animal-I put-u tie-oh [Chorus] Animal-I wear agbada [Chorus] Animal-I put-u suit-u Dem go hold meeting, oh, Dem go start yab human beings Animal talk don start again Dash dem, human rights Dem go hold meeting, oh, Dem go start yab human beings Animal talk don start again Dash dem human rights How animal go know-say dem no born me as slave? How animal go know say slave trade don pass? And, dey wan dash us human rights Animal must talk to human beings Give dem human rights I beg-I, oh, make you hear me well-u well I beg-I, oh, make you hear me very well Human rights na my property So therefore, you can’t dash me my property Human rights na my property Dey wan dash us human rights Some people say, “Why I dey talk like dis, No be talk like dis, dem take to carry me go prision ee-oh” No be me dey talk, na Prime Minister Botha dey talk, ee-oh Him say, “this uprising will bring out the beast in us” [Chorus] this uprising will bring out the beast in us Eh Ji Keke- my argument Botha na friend to Thatcher & Reagan Botha na friend to some other leaders too And together dem wan dash us human rights Animals wan dash us human rights Animal can’t dash me human rights Animal can’t dash us human rights [Chorus] Many leaders as you see dem [Chorus] Na different disguise dem dey-oh [Chorus] Animals in human skin [Chorus] Animal-I put-u tie-oh [Chorus] Animal-I wear agbada [Chorus] Animal-I put-u suit-u Beasts of no nation- Egbe Ke Gbe na bad society [CHORUS] Beasts of no nation, egbe ke gbe [CHORUS] Beasts of no nation, oturu gbe ke Easy… easy | BEASTS OF NO NATION O’feshe-Lu [Chorus] Aiya kata O’feshe- g’Ba O’feshe-Woh [Chorus] Aiya kata O’feshe-Weng Aiya kata Aiya Koto Aiya Kiti Aiya Kutu O’feshe-Lu [Chorus] Aiya kata O’feshe- g’Ba |